Sowore rearrest: Buhari goment defend why Nigeria secret police gbab di Publisher of Sahara Reporters

Nigeria President Muhammadu Buhari on Sunday defend di decision of di kontri secret police to rearrest Omoyele Sowore, di Publisher of Sahara Reporters.
Garba Shehu, wey be di main tok tok pesin to di President say no goment go allow anybodi to come out say dem go scata di kontri without doing anytin.
Di goment statement wey oga Shehu sign and release on Sunday 8 December, 2019, say Sowore na pesin of interest to di DSS - Department of State Service (wey be di kontri secret police).
Sowore call for revolution to overthrow di goment of President Muhammadu Buhari wey pipo elect under democracy inside Nigeria on 23 February, 2019, according to di statement.
Dis goment statement dey react to how DSS dey treat Omoyele Sowore mata afta dem rearrest am on Friday 6 December, just 24 hours wey dem bin release am from 124 days detention.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
"DSS no really need permission from di office of di president for all cases before dem go fit do dia work wey dey inside Nigeria constitution - wey be di foundation of di democracy of di kontri since 1999. Na wetin di statement add put.

Wia dis foto come from, Sahara Reporters
On Friday, 6 December DSS rearrest Oga Sowore from inside court compound for Abuja, afta dem bin release am on Thursday 5 December wia im don spend 124 days since im first arrest ontop dis mata.
But di kontri secret police later release statement on Saturday 7 December, wey tok say no be dia men enta court to rearrest Sowore.
End of Di one wey oda users dey read well well
DSS insist say na Sowore guys na im stage di abracadabra drama wey bin happun inside court.
But Sahara Reporters wey be di tori pipo wey dey work for oga Sowore say wetin di DSS tok for statement no pure.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Di Department of State Service even tok say shortly afta dem free Sowore on Thursday im begin do press conference dey tok tins wey be threat to national security.
But Sowore Lawyer, Femi Falana tok for one TV interview say "up till now we neva understand why DSS arrest my customer."
Oga Sowore dey face seven count accuse from Nigerian goment of treasonable felony and money laundering.
Di President office say "e no suppose surprise anybodi wey dey follow Oga Sowore behaviour and action to know say im go be pesin wey DSS go dey interested in.
Di next date for Sowore case for court go be February 11, 2020.
Di mata don attract plenti reactions across Nigeria and abroad.














