#RevolutionNow: Femi Falana, odas show for press conference

Wia dis foto come from, Getty Images
Men of di Nigeria Police bin block di venue for di planned press conference wey Nobel laureate Professor Wole Soyinka suppose do.
As di security forces tell journalists make dem do about turn, na so human rights lawyer Femi Falana (SAN) show.
Im follow tok to tori pipo and di police before im come enta di venue for di symposium.

Dis one dey follow as Nigerians and activists dey para say di Department of State Services (DSS) just dey arrest pipo anyhow anytime dem wan do I-no-go-gree waka ontop tins wey dey happun for di kontri.
Di #RevolutionNow protest wey follow join for di release of Omoyele Sowore, bin shele on August 5 all over Nigeria and police even use tear gas pursue pipo.
DSS bin pickup Sowore, wey be di convener of #RevolutionNow protest, on August 3 sake of say im get hand for di anti-government protest.
You fit watch di conference hia live.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Check out dis foto dem for di venue of di suppose press conference.
End of Di one wey oda users dey read well well
















