Sowore Revolution Now: Wetin to sabi about Omoyele Sowore, di man wey dey ginger protest across Nigeria

Omoyele Sowore

Wia dis foto come from, Omoyele Sowore

Wetin we call dis foto, Sowore dey 48 years old.
    • Author, Daniel Semeniworima
    • Role, BBC Pidgin, Lagos
  • Read am in 2 mins

Nigerians go wake on Monday August 5, to know weda di protest against bad governance wey Omoyele Sowore dey ginger for , go hold after authorities arrest am last Saturday.

Secret spy police - Department of State Services (DSS) don tok say dem arrest Sowore "for threatening public safety, peaceful co-existence and social peace inside di kontri."

Since wey dem arrest Sowore, na so many ogbonge Nigerians dey condemn di move, some don say di protest must go on, but who be dis man wey dey dinger Revolution Now across Nigeria?

Meet Omoyele Sowore

  • Omoyele Sowore no be today meat, na since di days of June 12, 1993 na im e begin ginger for Nigeria mata.
  • Him na son of Ilaje land for Ondo State, South West Nigeria.
  • Born February 17, 1971, Sowore na human rights activist, pro-democracy reformer.
  • Na him be di founder of tori pipo, Sahara Reporters wey e start for 2006 inside one small room for Manhattan, USA.
  • He get Bachelor's Degree (Geography and Regional Planning) University of Lagos from 1989 to 1995 (But e get two extra years sake of Aluta ginger).
  • E become Student Union Goment (SUG) President, University of Lagos between 1992 and 1994 (E follow lead serious protest against military goment wey bin cancel June 12, 1993 Presidential election and fight against goment corruption).
  • He also get Master's Degree (Public Administration) from Colombia University.
  • E become Presidential Candidate of di African Action Congress during di February 2019 Presidential election for Nigeria.
Skip Facebook post, 1

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 1

Sowore ('Showore' as dem dey pronounce am) na Nigerian wey don spend di last 15 years to dey work to promote human rights and democracy inside Nigeria, and to stop di military rule and gbege wey foreign oil companies cause for im kontri.

For 1989, Sowore follow for student 'I-no-go-gree' waka to protest di conditions wey dey inside one International Monetary Fund (IMF) loan of $120 million goment bin wan use for one Nigerian oil pipeline construction - di IMF loan conditions na to reduce di number of universities in di kontri from 28 to just five.

Skip Facebook post, 2

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 2

For 1992, wen im dey University of Lagos, Sowore lead 2,000 students in protest against Nigeria corrupt leaders. Police open fire, kill seven. Sowore chop arrest ontop di mata but he no gree to back down im Aluta struggle for decent education inside im kontri.

For early 2018, Sowore launch im presidential election campaign wit 'Our Mumu don do' slogan wey e say na mistake say young pipo comot hand for Nigeria mata.

Di 48 year old don enta imprison eight times before now ontop dis Aluta struggle for Nigeria.

Wetin we call dis Video, Sowore say na mistake say young pipo comot hand for Nigeria mata