Revolution protest: Nigeria Police don tag Sowore march as treasonable offence

Wia dis foto come from, Sahara Reporters
Di Nigerian Police don call di protest wey one group dey plan to do across di kontri on August 5, 2019 treasonable offence.
Dis na afta dem see video of one 'Global Coalition for Security and Democracy in Nigeria' and others wey dem say dey try force change of regime for di kontri wit di protest wey dem dey call 'Revolution Now'.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
AAC presidential candidate Omoyele Sowore wey be one of di main pipo wey dey mobolize di 'Revolution Now' protest bin report say secret police (SSS) arrest am on Saturday, August 3 but police say dem no know anytin about am.
Di Inspector General of Police Mohammed Adamu, bin announce for statement say di word "revolution" mean say "dem go use force and violence to take ova power".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Tho di police say Nigerians get right to protest, dem also warn say dem go bring di full arm of di law for any pesin wey join dis "criminal act".
Meanwhile, di National Labour Congress and di Trade Union Congress don announce say dia hand no dey di protest.
Presido of NLC Ayuba Wabba tok say none of di unions wey dey under dia joinbodi dey involved in di organising of di Revolution protest.








