Revolution meaning: Egyptian Revolution, Arab Spring, Occupy Nigeria, wetin #RevolutionNow protest resemble

Occupy Nigeria

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI

Read am in 6 mins

Protesters dey plan to gada again on Tuesday August 6 to continue dia #RevolutionNow protest inside Lagos South West Nigeria.

One of di organisers Usman Oloyede tell BBC dis morning say for now dem dey find way to release those wey police arrest on Monday.

From 'Arab Spring' wey happun for Tunisian, Libya, Egypt, Yemen, Syria and Bahrain, where either di pipo remove di goments or change di system to 'Occupy Nigeria' wey be fuel price increase protest wey bin happun for 2012 across major cities inside di west African kontri, no be today pipo dey decide say 'Enough is Enough' for dia kontri.

A revolution na di successful attempt by large group of pipo to change di political system of dia kontri by force, according to Collins Dictionary. But organizers say di protest na against bad goment inside Nigeria.

Wen di protest start, security pipo enta streets fire tear gas, check pipo phones, arrests di ones dem fit arrest, for Lagos on Monday as supporters of di Revolution Now protest for Nigeria say dem go still go ahead wit dia protest.

Nigeria spy secret police Department of State Security Service (DSS), arrest di main organiser for weekend. Tok tok pesin for DSS say dem detain Omoyele Sowore sake of im wan "overthrow di Nigeria goment."

Occupy Nigeria vs #RevolutionNow

Di two fit look alike but Occupy Nigeria nah socio political protest wey begin for Nigeria on Monday 2nd January, 2012 on top fuel subsidy wey the goment of President Gooodluck Jonathan comot on Sunday 1st of January

Di protest happun for Abuja, Lagos, Kano and di Nigerian High commission for London .

Wetin characterize di protest nah civil disobedience, civil resistance, strike actions, demonstrations and online activism. Di use of social media services like twitter and facebook.

On Monday di #RevolutionNow protesters for Lagos tell BBC say 'wetin dem see on Monday for Lagos only happun during di time wey di late General Sani Abacha rule and di Nigerian Police don call di protest across di kontri on August 5, 2019 treasonable offence.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Oda revolution wey don shake di world.

Occupy Nigeria

Wia dis foto come from, Other

Grey line wey dey

ARAB SPRING - 2010:

Dis nah series of anti-goment protests, uprisings, and armed rebellions wey spread across North Africa and di Middle East for early 2010s.

Wetin start am nah di oppressive regimes and low standard of living wey pipo dey suffer - di same reason wey make di organizers of di 'Take It Back #RevolutionNow protests for Nigeria dey giner 19 years later.

Di protest start for Tunisia and e spread to five oda kontri like Libya, Yemen, Egypt, Syria and Bahrain

For dis kontries dem either topple regime or major uprisings and social violence happun for dia, wetin happun also include, civil war or insurgence.

Sustained street demonstrations happun for placefor Morocco, Iraq, Algeria, Iranian Khuzestan, Lebanon, Jordan, Kuwait, Oman and Sudan. Minor protests happun for Djibouti, Mauritania, di Palestinian National Authority, Saudi Arabia, and di Moroccan-occupy Western Sahara

Di major slogan for di demonstrators for Arab world nah ash-shaʻb yurīd isqāṭ an-niẓām (Di pipo wan bring down di regime").

Egyptian Revolution - 2011 Wey pipo sabi as di January 25 Revolution

Dem set date for the protest wey go coicide wit di Egyptian police holiday wey dem dey do evri year dis nah to make statement against increasing police brutality wey happun for di last few years of Mubarak's presidency.

E start for 25 January 2011 and e spread across Egypt. For di protest wetin dey nah demonstrations, marches, occupations of plazas, non-violent civil resistance, acts of civil disobedience and strikes.

Millions of protesters from different socio-economic and religious backgrounds dey demand di overthrow of Egyptian President Hosni Mubarak.

Nah 846 people lose dia life for di Violent clash between security forces and protesters and over 6,000 injure Protesters still retaliate burn over 90 police stations across di kontri.

Days: 18

Pipo wey die - 300

Goal: To overthrow President Hosni Mubarak and do free democratic elections.

Di plan work small.

Grey line wey dey

Tunisia Revolution 2010-11 Wey pipo sabi as Jasmine Revolution

Di Tunisian Revolution nah intensive 28-day campaign for civil resistance.

E include series of street demonstrations wey happun for Tunisia, and nah im lead to di ousting of longtime president Zine El Abidine Ben Ali in January 2011. E eventually lead to a thorough democratisation of di country and E lead to free and democratic elections

Days: 30

Pipo wey die - 147

Goal: To remove dia corrupt President Zine al-Abidine Ben Ali.

Di revolution no work.

Ogbonge Revolutions for Africa history

Algerian Revolution or Algerian War (1954-62) Di Algerian war wey pipo also know as di Algerian war of independence or di Algerian war of revolution bin start wella by members of the National Liberation Front (FLN) for November 1, 1954 during di Toussaint Rouge ("Red All Saints' Day) di conflict lead to serious political wahala for France, e cause di fall of the Fourth French Republic from 1946 - 1958., e replace the fifth Republic with ogbonge Presidency.

ANGOLAN WAR OF INDEPENDENCE OR ANGOLAN REVOLUTION (1961-74)

Di Angolan war of independence bin start as fight against by fire by force cotton cultivation, e come later become multi-faction struggle to control Portugal's overseas province of Angola among three nationalists movements and a separatist movement. Di war end wen one Leftist military coup for Lisbon in April 1974 commot Portugal's Estado Novor regime, di new regime sharp sharp stop all military actions for Africans colony, e tok say wetin e wan do na to grant dem independence witout delay.

EGYPTIAN REVOLUTION OF 1919:

Dis one na d whole contri dey against di British occupation of Egypt and Sudan. Na Egyptians do di revolution wen di British tok say make di revolutionary Egyptisn Nationalist oga, Saad Zaghlul, go exile and oda members of di Wafd party for 1919.

Di revolution na im allow Great Britain later recognize Egyptian independence for 1922 as di Kingdom of Egypt and di implementation of a new constitution for 1923. Britain no gree to accept Egyptian power on top Sudan or make di contri comot im forces from di Suez Canal Zone, all dis na things wey go continue to cause wahala between Anglo-Egyptians relations for decades to come wey come lead to the Egyptian revolution of 1952.

EGYPTIAN REVOLUTION FOR 1952: Di revolution start for July 23, 1952, by di Free Officers Movement, a group of army officers led by Mohammed Naguib and Gamal Abdel Nasser. Di plan of di coup na to comot King Farouk.

However, di movement get more political ambitions as e soon move to comot di constitutional monarchy and aristocracy of Egypt and Sudan, di movement establish republic, end British work for di contri, e come secure di independence of Sudan (wey bin dey under Anglo-Egyptians condominium). Di revolutionary goment accept nationalist and anti-imperialist agenda, which dem carry out through Arab nationalism and international non-alignment.

1969 LIBYAN COUP D'ETAT OR LIBYAN REVOLUTION: Di 1969 Libyan coup d'etat wey pipo also know as di Al-Fateh Revolution or di September 1st Revolution na military coup d'etat wey happun for Libya, na Free Officers Movement carry am out, a group of Military officers led by Colonel Muammar Gaddafi, e lead to di overthrow of King Idris.

RWANDA REVOLUTION (1959-61): Wey pipo also know as di Social Rvolution or Wind of Destruction (Kinyarwanda: Muyaga) na period of ethnic violence for Rwanda from 1959 to 1961 between di Hutu and di Tutsi, two out of di ethnic groups wey dey Rwanda. Di revolution see say di contri leave Belgian colony with a Tutsi monarchy to one independent republic wey Hutu pipo dem dominate.

SOMALI REVOLUTION OR SOMALI REBELLION (1986-92): Di Somali Rebellion na im begin civil war for Somalia, e happun aound 1970s and early 1990s. Di rebellion start for 1986 wen Siad Barre begin attack clan based dissident group wey dey oppose to his rule wit special forces, di "Red Berets". Di dissidents don dey become powerful for many years as he stop to dey support di Soviet Union to di United States and di disastrous Ogaden war wey happun between 1977-1978.

ZANZIBAR REVOLUTION (1964): Zanzibar revolution happun for 1964. Local African revolutionaries na dem start di revolution wey lead to di overthrow of di Sultan of Zanzibar and Arab goment. Zanzibar na contri wey get plenty diverse states and plenty islands off east coast of Tanganyika wey Britain grant independence for 1963. For plenty parliamentary elections wey hold before independence, di arab people wey no plenty hold power e get from Zanzibar's former existence as an overseas territory of Oman.

Ogbonge Revolutions wey happun cross di world.

Grey line wey dey

Ukraine - 2004

Days: 37

Pipo wey die- 0

Goal: To cancel election mago-mago election and do anoda one and end corruption.

Dis plan work small but no be everything wey dem want.

Grey line wey dey

Indonesia - 1998

Days: 10

Pipo wey die- at least 1,000

Goal: To overthrow di oppressive regime of Suharto and

To overthrow the oppressive regime of Suharto and stop padi- padi politics.

Dem achieve dia goal.

Grey line wey dey

Tiananmen (China)- 1989

Days: 51

Pipo wey die- at least 3,000

Goal: To establish democracy, and stop di one party rule wey go end corruption.

Di revolution no work.

Grey line wey dey

Iran: Jan 1978 - Apr 1979

Number of days- 448

Pipo wey die- 3000

Goal: To overthrow Shah. Democrats start popular uprising, but Islamists dem take over.

Dem achieve dia goal.