Xenophobia: Buhari tell Ramaphosa to copy how e stop do-me-I-do you attacks for Nigeria

Buhari and Ramaphosa

Wia dis foto come from, Bashir Ahmad

Read am in 3 mins

Nigeria President Muhammadu Buhari don ask di goment of South Africa leader Cyril Ramaphosa to make sure say di kind recent attacks on foreign nationals no go ever happun again.

Buhari bin lead di Nigeria delegation to participate for di 9th session of di Nigeria/South Africa bi-national commission wey involve Ramaphosa and South Africa top goment officials.

"My goment don take action to prevent a repeat of do-me-I-do-you attack on South Africa businesses and we call on President Ramaphosa administration to do di same with regards to attacks on foreign nationals wey dey South Africa," na so Buhari bin tok today for di meeting.

Earlier, for di joint press conference wey di two leaders do, oga Ramaphosa say South Africa no go ever forget how Nigeria help dem during dia Apartheid rule.

"We also wan use dis opportunity tok say South Africa and our goment regret di violence wey happun for parts of our kontri some weeks ago, wey dey directed at some foreigners, some of dem wey come come from your kontri," Ramaphosa bin tok ontop di xenophobia mata.

South Africa economy don suffer well dis year and Ramaphosa say dis fit bin wetin make citizens para begin attack foreigners.

"We go like assure you say South Africa dey committed to di ideals of African unity and solidarity, to respect pipo human rights and to ensure say South Africa dey do wetin dey law book."

"While we dey address di economic and social conditions wey don make some our pipo dey vex, we dey firmly condemn all kind of intolerance and no go look two times before we act against acts of violence."

Buhari and Ramaphosa

Wia dis foto come from, Twitter/@NigeriaGov

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

South Africa International Relations and Cooperation Minister Naledi Pandor tok on Wednesday wen she host Nigerian Foreign Affairs Minister Geoffrey Onyeama for bi-lateral talks, say dis recent palava neva harm di relations between South Africa and Nigeria.

Na since 1994 na im South Africa and Nigeria dey padi padi for political, economic and social mata, afta South Africa do im first democratic elections.

Buhari just land South Africa and na di foreign minister go welcome am

Wia dis foto come from, Bashir Ahmad

Wetin we call dis foto, South Africa International Relations and Cooperation Minister Naledi Pandor na im welcome President Muhammdu Buhari for night on Wednesday.

Recently, Nigeria through di oga of Air Peace Allen Onyema helep over 300 of im kontri pipo wey dey run from xenophobic attacks from South Africa come back dia kontri.

Dis attack bin make Nigerians para say make goment close all di South African business wey dey di kontri.

For state house press release, President Buhari tok say some of di mata wey dey to discuss nah how Nigerians wey dey di kontri go dey live for dia with no katakata.

Buhari add say im go hold town hall meeting with dem to tok wetin dem dey face and how goment fit protect dia lives and property.

South Africa International Relations and Cooperation Minister Naledi Pandor na im welcome President Muhammdu Buhari for night on Wednesday

Wia dis foto come from, Bahsir Ahmad

According to statement from di South Africa president, part of wetin dey bring dis state visit nah for di two kontris to torch light trade and investment mata wey dey between dem.

"South African companies wey dey Nigeria get ogbonge business for different sectors like telecommunications, banking, retail, hospitality, mining, tourism, agriculture and construction and tourism". Na so Presido Ramaphosa tok.

Dis state visit no be only to provide opportunity for di two presidents to tight di political, economic, social and cultural relations wey dey between dem kontris, na to also create space to tok on mata wey concern mutual interest of di continent and global governance.

At di end of di meeting di two leaders go sign agreement wey dey protect dem interest for di kontris.