You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Bashir Ahmad delete claim say police rescue kidnap victims
Presido Muhammadu Buhari special assistant on digital media, Bashir Ahmad, don remove one Tweet wia im claim say Nigeria police rescue three university students wen bad pipo bin kidnap.
Di police tok-tok pesin for Kaduna state police, Yakubu Sabo, bin tell BBC Pidgin on Wednesday say dem secure di release of di students and dem don unite dem wit dia families.
Na dat same tori say police get hand for di release of di girls wey dem bin kidnap on Monday for di Abuja-Kaduna road oga Ahmad come post for Twitter, but don delete now.
For wetin im post as to why im delete di tweet wey say police rescue di girls, im say na based on information im get from di girls families:
One Sadiq Ango na im be one of those wey bin first react to Ahmad tweet as im say dem negotiate wit di "kidnappers to secure di release of our sister to us not di police":
Sadiq tell BBC Pidgin say one of di girls na im cousin and say "no police involve for di negotiations and di release."
"Di ransom na for Rijana town we pay am and dem release di captives to us wia dem waka several kilometres before our family members wey dey search for dem see dem," im add.
Also, two tweets from dis users also attack wetin di presidential aide tok about how di students take free:
End of Di one wey oda users dey read well well
But Kaduna police tok-tok pesin, Yakubu Sabo, don clarify to BBC Pidgin say police no "directly" involve for di release of di girls.
Im say na six pipo dem bin kidnap and say police sharp intervention force di kidnappers to release di first three pipo wey bin dey dia hand.
"Police no go fit negotiate wit criminals, all we fit do na to see say we fit do anything e go take to release dem.
"Police no go fit stop family to negotiate, but dat no go stop us to do our own work.
Im add say police don dey involved for di operation since di beginning and say pesin no go fit minus di work wey police do for di release.
Kidnapping for ransom dey happun wella across Nigeria and some victims and dia families don come out to tok how much dem pay for dia release.
Nigeria police dey sometimes tok say dem don rescue victims, but dem no dey tok di role wey di family play to secure di release.