Eid-el-Kabir: Three tins Buhari tok for im Sallah message

President Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, Instagram@muhammadubuhari

Nigeria President Muhammadu Buhari celebrate Eid-el-Kabir togeda with di President of Guinea Alpha Conde, for im hometown for Daura, Katsina northwest Nigeria.

President Buhari along with im guest, President Conde, join oda Muslim faithful around Nigeria and di world on Sunday to observe di Eid-El-Kabir prayers as well as to celebrate di day.

Di president wey release statement to wish all Muslims around di world happy Eid-el-Kabir celebrations also use di opportunity to send strong message give not only Muslims but di whole kontri.

Buhari Eid message

  • President Buhari tok inside im message say Boko Haram become so powerful because Muslim societies do I don care wen preachers wey dey manipulate innocent pipo wey dey easily convinced begin dia activities. Im add say Muslims must work to be di mirror through which oda pipo go see di good tins about Islam wey be religion of peace and also reject all those ideas wey dey give di religion bad name.
  • President Buhari insist again say Boko Haram power no dey as before again. Di president say despite some setbacks here and there, di armed forces don weaken and scata di terrorist group and dem no longer dey in a position to occupy any part of Nigeria again let alone lift dia flag to occupy and exercise dia power for more dan 24 hours.
  • President Buhari nack chest say im administration no go only deal with Boko Haram, but kidnapping, cultism and oda form of jaguda activity. Di president give assurance say as di armed forces get more equipment, training and motivation, dis administration dey committed to protect Nigerians and to end dis evil once and for all.

Aside di message and promise, di president spend di day with different activities.

President Nuhammadu Buhari and Members of Daura community dey welcome Guinea President Alpha Conde

Wia dis foto come from, Twitter/@GarShehu

Wetin we call dis foto, President Nuhammadu Buhari and Members of Daura community dey welcome Guinea President Alpha Conde

Dem organise ogbonge Durban ceremony to celebrate and honour di Guinean president, di Emir of Daura , Umar Faruk Umar turban am, give am di title, 'Talban Daura' to appreciate am for im love for President Buhari and im visit to Daura.

Nysc members with President Muhammadu Buhari and President Alpha Conde

Wia dis foto come from, Twitter/@GarShehu

Wetin we call dis foto, NYSC members pose for foto withNigeria President Muhammadu Buhari, Guinea President Alpha Conde and oda dignitaries during di Ei-el-Kabir celebration

President Buhari also receive oda dignitaries and visitors including members of di National Youth Service Corps wey come celebrate with am.

Im use di opportunity to tok about di NYSC programme and e impact as something good to unite Nigeria.