Arafat day: Why e dey important for Muslims

Muslims dey pray for Mount Arafat on August 20 2018

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims dey pray for Mount Arafat on August 20 2018

Di day of Arafat fall on di 9th day of di Islamic calendar wey dem dey call Dhul-Hajjah, wey be di second day of hajj. Na ogbonge and important part of di annual pilgrimage wey Muslims dey do for Mecca.

Afta sunrise on dis day, millions of pilgrims wey go fo hajj go begin di journey to Mount Arafat wey dey outside di city of Mecca.

Wetin Muslims suppose do and dey do on dat day?

  • Na on Arafat day, prophet Muhammad (SAW) for di last Hajj wey im perform before death say religion of islam don dey complete and from dat day no any new revelation come to am again
  • One of di greatest disciples of di prophet Umar tok say to some religion dat day for become day to celebrate and jolly because na day wey di religion complete.
  • Prayers on Arafat day for pipo wey go Hajj na di most special of prayers and di one wey God value di most. Di prophet tok with im mouth say "di most special prayer na di one wey happun on Arafat Day."
Muslims dey pray for Mount Arafat on August 10 2019.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims dey pray for Mount Arafat on August 10 2019.
  • Na on Arafat Day God dey change many pipo destiny from hell fire to paradise. Prophet Muhammad (SAW) use im mouth tok say "no day wey Allah dey save pipo from entering hell fire like on Arafat Day."
  • For pipo wey no go Hajj for every part of di world, Arafat day na to fast from dawn till sunset because na something wey dey cleanse sins of two years. According to di prophet, "fasting on Arafat day dey clean sins of pipo for two years, di one wey pass and year wey dey come."
  • Arafat nah di second day and di ogbonge day for Hajj wey pilgrims dey gather on top Mount Mercy for Arafat, wey dey near Makkah. Mount Arafat nah di the site where Prophet Mohammad give im farewell sermon
Graphics wey show di stages of Hajj
  • Na day wey God dey proud of pipo wey go do Hajj, according to Imamu Ahmed.
  • Arafat day nah di day before Eid-al-Adha. For di Islamic calendar, e dey hapun 70 days afta Ramadan, Di occasion dey mark di day wen Islam dey perfected, and Allah's blessings dey complete according to one verse inside di Quran.
  • On dis day, all Muslims wey no fit make am to Mecca dey fast and di ones wey make am to Arafat go spend di day dia dey pray.
  • To complete hajj, Muslims must stand ontop Mount Arafat or dia holy journey no go dey complete.