Sowore Revolution Now: Court grant DSS permission to hold di activist for 45 days

Federal High court for Abuja Nigeria don rule say Nigeria secret police, di Department of State Service, fit keep Sahara Reporters Publisher and di organiser of di Revolution Now protest, Omoyele Sowore for 45 days.
Dis wan na afta DSS apply for order to allow dem detain Sowore for 90 days to continue dia investigation wey involve terrorism.
DSS present video evidence for court as exhibit say Sowore dey with Nnamdi Kanu as well as one video wey show am dey tell di Shia members to join bodi with Revolution Now protest to bring di goment down.
Justice Taiwo Taiwo grant di 45 days afta im chook eye inside di evidence DSS present. Im also adjourn di mata to September 21.
E however add say, dem need to investigate di evidence wey DSS present well-well and prove am beyond doubt, di judge say di 45 days go give di DSS time to conclude dia investigation den afta dat time dem fit apply for extension.
Di 45 days start from Thursday August 8.
DSS arrest Sowore, di presidential candidate of di African Action Congress for di 2019 election on Saturday, afta im call for Revolution Now protest on Monday, August 5.
Tok-tok pesin for DSS, Peter Afunaya, bin tell BBC say, dem arrest di organiser of di protests wey dem call 'Revolution Now' on Saturday morning because im dey call for di overthrow of Nigerian goment.
End of Di one wey oda users dey read well well
Sowore Coalition for Revolution movement, bin call on Nigerians all ova di kontri to come out for streets and demand di end to insecurity.
Di group also want free education and healthcare for everibodi plus also make dem nationalise ogbonge economic sector for di kontri.
Dem promote dis plan protests for social media wit di hashtag Revolution Now.
Meanwhile, Nigeria Police on Tuesday carry six pesin wey dem arrest during di Revolution Now protest wey happun on Monday go Ebute Metta Chief Magistrates court for Lagos on-top two count charges of unlawful assembly and conduct wey fit cause breach of peace.
Di tok-tok pesin for Lagos state police command, DSP Bala Elkana wey confam dis give BBC Pidgin say everytin now dey for di hands of di court to decide weda dem go grant di protesters bail or not.













