Insecurity: Kidnappers gbab five RCCG Pastors for Ijebu-Ode

Wia dis foto come from, PAstor Adeboye/Facebook
Kidnappers don gbab five Redeemed Christian Church of God (RCCG) ministers for Ijebu-Ode, Ogun State, South-West Nigeria.
Di kidnappers take di pastors hostage for di early hours of Friday morning.
BBC understand say di pastors been dey on dia way to di Church yearly convention wey dey hold every August for dia Redemption Camp wey dey for Mowe, Ogun State.
One of di pastors of di church wey dey on ground for di convention tell BBC say di General overseer of di church, Enoch Adeboye mention am for service dis morning as dem raise prayers for di victims.
Ogun State police tok tok pesin Abimbola Oyeyemi wey also confirm di tori to BBC say di police for now "no know weda di pipo be pastor or not."
Im add say: "Di commissioner of police na im dey personally lead di operation to rescue" di five pipo wey include four men and one woman.
Dis tori dey come only days after Nigeria President Muhammadu Buhari say dem go use drones to monitor forest and oda hideouts wey criminals dey operate for southwest of di kontri.
Dis move dey come even as kill-kill and kidnapping don increase for some parts of di kontri. Last month, gunmen kill di daughter of Afenifere group leader for Ore area of Ondo state.
End of Di one wey oda users dey read well well














