Nigerian army rescue 13 farmers from kidnappers hand

Wia dis foto come from, Twitter/@HQNigerianArmy
One pesin don die afta di Nigerian army put san-san inside di garri of jaguda pipo on Monday for Kaduna State, north west Nigeria..
According to statement wey di army release, di pesin wey die dey among di jaguda pipo wey come kidnap 13 farmers as dem dey do work for dia farms for Kuyelo community, Birnin Gwari local gofment area of di state.
Di tori be say di patrol team of di 1 Division Nigerian Army wey station for Super Camp Kuyello, for di exercise HARBIN KUNAMA 111 exchange gun fire with di jaguda pipo, kill one of dem to recover di farmers wey dem kidnap.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di Army report say dem hear di tori afta some good Samaritans call dia attention to am, so dem decide to take action.
Di Army tok say di remaining pipo escape with gun wounds and soldiers dey currently find dem for di areas wey get borders with Kastina, and Zamfara states.









