Senate President: Sentor Ali Ndume say im no go step down for Ahmad Lawan

Ali Ndume

Wia dis foto come from, The Nigerian Senate

Wetin we call dis foto, Senator Ali Ndume on Thursday warn say Senate fit dey under threat of parliament independence wit di way tins dey go.
Read am in 3 mins

One of di ogbonge competitors for di position of senate President for di Ninth National Assembly wey wan enta soon, Senator Ali Ndume, don re-tok am again say im wan contest for di floor of di Senate on June 11.

Ndume tok dis one for one interview wey im do wit journalists on Thursday.

E also tok say e no get any reason to visit President Muhammadu Buhari for di Presidential Villa to step down for Senator Ahmad Lawan, wey be di candidate of All Progressives Congress for di position.

Di former Senate Leader also tok say na lie for dat social media report wey spread say President Buhari invite am come di Villa and direct am to stop im to contest for di Senate President position.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

E tok say, "Nobody don invite me come di Villa. No need go dey for dat one. My plan to contest di Senate President election Insha Allah on Tuesday next week still stand."

Earlier, Senator Danjuma Goje step down for Senator Ahmed lawal as di candidate wey Nigeria goment party APC go use contest for di next Senate President.

Goje dey shake President Buhari

Wia dis foto come from, ElRufai/Twitter

Goje step down afta dem do meeting wit President Buhari for Aso Rock on Thursday afternoon, according to Ahmad Bashir wey be presidential assistant to Muhammadu Buhari.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Na for March 2019 di All Progressive Congress announce say e don adopt senator Ahmed Lawan as senate president for di ninth Assembly.

During Thursday meeting na Govnor Nasir Ahmad Elrufai of Kaduna, Senate Leader, Ahmed Lawan, Senator Ahmed Goje and Senator-elect, Uba Sani wit President Muhammadu Buhari na im dey for di meeting for State House.

Senate Valedictory Session: We fight for democracy and hold goment accountable - Saraki

I no get any regret to fight for democracy and hold goment accountable na wetin Bukola Saraki tok.Di President of di 8th Senate, Bukola Saraki and oda principal officers don take dia bow afta di valedictory session to mark di end of di tenure.

Abubakar Bukola Saraki

Wia dis foto come from, Abubakar Bukola Saraki

Oga Bukola wen e dey address im colleagues say need dey for di kontri to build strong democratic institutions wey go epp develop di kontri.

E say although di 8th senate face plenti kasala during di tenure plus say I'm too suffer wella for Code of Conduct Tribunal, di 8th senate try dia best to make law wey touch ordinary pipo."We gatz dey proud of our legacy for di people. We form plenti round table to address issues wey dey affect ordinari pipo for we kontri and we address issues like drug abuse and human trafficking."

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Saraki also explain give say need dey for executive arm of goment to constantly do tok tok wit di legislators on top di issue of budget, adding dat di National Assembly no be rubber stamp and di executive gatz understand say additions to the budget na part of National Assembly responsibilities.

He also note say even if di Assembly no confam some appointment by di president no mean say na quarrel and dat need dey for di two arms of goment to work togeda to build beta goment for Nigerians.

Failure not to confirm some appointment no be to cause quarrel. E say e go define di 8th Senate as lawmakers wey fight for democracy and hold goment accountable.