Lagos heavy rain fall two buildings, trees and electric poles

Tree

Wia dis foto come from, @lasemasocial

Wetin we call dis foto, Officials of LASSEMA as dem dey try clear di tree wey fall for Ikoyi

Heavy rain wey hama Lagos State on Monday scata many things for different parts of di state, and cause traffic wey stand gidiba for many hours.

Di rain wey start around 8:30am, come wit heavy breeze and by di time e finish, two buildings collapse, many trees and electric poles also fall.

Di Lagos State Emergency Management Agency LASSEMA say one building fall for Abule Egba and anoda one for near Ladipo Bus stop, Oshodi. Dem say no update dey yet on pipo wey di collapse building fit don affect.

Dem also post photo dem of di kain scata-scata wey di state carri eye see for di rain hand on Monday.

Tree and car

Wia dis foto come from, @lasemasocial

Wetin we call dis foto, Dis tree fall ontop moto for di Alfred Rewane road for Ikoyi, wey make traffic tie wrapper for di road

Few hours later, dem come post photo wia dem don clear di tree:

tree

Wia dis foto come from, @lasemasocial

Wetin we call dis foto, Dem dey pieces di tree finish and pack am dey comot

Dem also post foto of di building wey fall:

Building wey fall

Wia dis foto come from, @lasemasocial

Di heavy rain bin cause serious flood for roads:

flood
cars
Cars

Di flood wey dey road cause serious traffic, especially for di Lagos - Ibadan expressway:

Traffic
Traffic
Car dem dey push
Wetin we call dis foto, Di flood spoil some pipo moto

Even officials of di Federal Road Safety Corps wey suppose start operation 'Show your Drivers Licence' for di state on Monday, begin help to control traffic.

FRSC officials