Oshodi road: President Buhari come commission projects wey neva complete - Lagos pipo para

Wia dis foto come from, Lagos State Government
Nigeria president Muhammadu Buhari don tear rubber comot di Institute of Maternal and Child Health, Ayinke House wey dem upgrade for di Lagos State University Teaching Hospital (LASUTH)Ikeja.
Dem upgrade Ayinke House from 80-bed facility to 170 bed healthcare centre wit state-of-the-art medical equipment, as well as information technology services.
Di president throway accolade give Lagos state goment say na ogbonge tin dem do for di health sector.
Lagos state govnor Akinwunmi Ambode tok say di facility go provide world class service for both pikin and mama, during childbirth, di hospital go also service oda residents of Lagos and Nigeria.
Di President also commission di 500-seater Lagos Theatre for Oregun, Ikeja.
Aside from Ayinke House and di Lagos Theatre Oregun, presido Buhari go also commission oda projects like Oshodi Transport Interchange; New mass Transit Bus and Airport Road.

Meanwhile residents for Lagos, South West Nigeria, bin dey hala for social media as news break say President Muhammadu Buhari go visit di state to commission some projects for di state.
Some Lagosians say di Ikeja bus terminal wey di President commission last year still dey under construction till now and na so-so project wey no dey complete e dey come tear rubber for di state.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5
Wen BBC Pidgin reporter reach some of di project sites for Lagos, e see say true-true work still dey go on for some of dem.

For Oshodi interchange terminal construction workers full ground dey work as at Tuesday evening wen BBC reporter go look di place.
Also, for International Airport road, plenti construction workers dey dia dey work for some parts of di road. Work still dey go on for bridge wey dem dey build for dia.

Meanwhile, one pesin wey dey work wit di goment wey follow BBC Pidgin tok but wey no gree make dem call im name, say all di project don dey complete.
Concerning Oshodi road di person wey bi close aide to di governor tok say;
"If work dey go on for di road no mean say e no dey completed. Di fact say dem neva finish everytin 100% no mean say e no dey completed.
Pipo don dey use dat road since two weeks ago plus even dat one for under di bridge opposite di toll gate wey dey very close to di airport."
"Di overhead bridge coming from di airport to Oshodi dey complete, e just dey undergo quality assurance and di one wey dey come from Oshodi to airport na im dem dey work on to put finishing touch."
Di goment official add say di president no go come commission road wey no dey complete and e also send some foto of di projects to BBC Pidgin to take show say dem don complete di projects.

Wia dis foto come from, Lagos State goment

Wia dis foto come from, Lagos State goment
BBC Pidgin also try to reach di commissioner wey dey in charge of information for di state to tok on top dis mata but e number no go through.
While di Commissioner for Works neva still reply di email wey BBC Pidgin send give am on top di matter.