Man City: Citizens scata Liverpool 29 years dream to win 2018/2019 English Premier League title

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester City don win di 2018/2019 English Premier League title after dem win Brighton and Hove Albion 4-1.
City finish top of di table as dem use just one point pass Liverpool wey finish second.
With dis win Manchester City don win dia fourth Premier League title since dem name am for 1992.
Dem also become di first team to win am back to back Premier League title for di first time in ten years.
Ilkay Gundogan, Riyad Mahrez, Aymeric Laporte and Sergio Aguero na dem score all four of Man City goals to complete di turnaround after Brighton been score dem first.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di vctory for City end Liverpool 29-year wait to win di league title as dem go need try again next season.










