Nigeria killings: We go deal wit anybody wey dey epp cause kasala for di kontri - FG

Wia dis foto come from, Twitter/@NigAirForce
Nigeria goment don draw ear give any pesin or group wey dey epp jaguda pipo kili-kili and cause kasala for di North West of di kontri to comot hand or face di consequences.
Inside statement wey di Ministry of Defence release signed by tok-tok pesin to di Minister of Defence, Tukur Gusau, di Armed Forces of Nigeria get order to deal wit anybody wey dem find say dey epp di kili-kili pipo no mata who di pesin be.
According to di statement, di Ministry dey concerned wit wetin dey happun for di North-West especially for Zamfara, Sokoto, Katsina and Birnin Gwari axis of Kaduna state, because of dat Army don start exercise HARBIN KUNAMA IV for Zamfara, Katsina and Sokoto to flush out di jaguda pipo.
According to di statement, Armed forces effort to flush out di bandits don dey pay off as dem don kil many of di jagua pipo rescue some wey dem kidnap,
Di statement also point finger say some pipo including traditional rulers dem for high places dey support di jaguda pipo wit information to cause kasala.
Dis wan dey come as di kontri don record plenti kili-kili, kidnappings in di last few days.

Wia dis foto come from, Ahmed Sani
Kaduna
Local tori pipo for Nigeria say like twenty pipo don die and odas injure inside anoda attack by suspected Fulani herdsmen for Unngwan Aku village, Kajuru Local Government Area of Kaduna state, North West of di kontri.
According to Punch, pesin wey carry eye see as e happun say di attackers wear military uniform, enter di village around 7pm Monday evening, di men wey carry AK47 guns and cutlass shoot anytin wey dem carry eye see for di village.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Kajuru attack no be di first tori of kasala wey don comot from Kaduna recently.
Early dis year, goment confam say 66 pipo bin die for Kajuru wen gunmen attack.
Aside from dis one, to travel for di Abuja-Kaduna highway na sometin wey pipo dey avoid as kidnappers no dey allow pipo see road.
Many pipo don fall back to dey use train while police don begin operation "Puff Adder" to arrest di situation.

Wia dis foto come from, Twitter/GovKaduna
Zamfara killings
For plenti months now, residents for Zamfara state never fit drink water keep cup for ground as jaguda pipo continue to dey terrorise communities, dey kill, kidnap and destroy properties.
Although authorities never fit confam how many pipo don die since di crisis start for Zamfara, one resident Shehu Sani wey dey stay Kware town for Shinkafi LGA tell BBC Pidgin say dem don lose 250 pipo within di last three months.
"Na 250 pipo we lose for Kware town alone and I fit mention all dia names because na pipo wey I dey stay with and I know." Dis na wetin Sani yan.
Last week pipo march enta street to demand make goment do something fast.
Police oga Mohammed Adamu say dia operation "Puff Adder" dey ontop di situation.
On Sunday, goment announce di suspension of mining activities for di state say e get hand inside di crisis but some sabi pipo shake head say dat one no join.

Wia dis foto come from, Ahmed Sanni
Rivers
Rivers state for South-South of di kontri still dey battle dia own palava.
Eight pipo die for weekend for Mgbuo-Odohia village Rumuolumeni inside Obio Akpor Local goment area wen cult groups qwanta.
Although police dey ground dia now dey chook eye inside di mata, residents still dey fear, plenti pipo don run comot and shops dey locked as taxi, bus and keke pipo no gree ply dat route.

Ondo
Six pipo die on Monday wen armed robbers attack di First Bank for Ido Ani, Ose Local Government Area of Ondo State.
According to police, di pipo wey die include one police inspector, di Vice Principal of Ido Ani Grammar School, and employees of the bank.

Wia dis foto come from, The Nation Online
Lagos
For weekend for di commercial city of Nigeria, gunmen kidnap di state Fire Service Director, Rasaki Musibau and six oda pipo.
Dis one happun Saturday last week along Iwoye bridge for Itokin-Epe road for Ikorodu.
Tori be say di kidnappers don contact di family to ask for ransom.
According to police tok-tok pesin for di state Bala Elkana police dey ontop di situation.













