Kajuru Kaduna killings: Police, army don confam say pipo die

Nasir El-Rufai and security agencies

Wia dis foto come from, Kaduna Government

Nigeria police and army, don join Kaduna State goment for north west of di kontri to confam say true-true, pipo bin die for Kajuru area of di state.

Police no gree use mouth tok how many pipo di gunmen bin kill, but army say na 66 pipo die.

Confusion bin dey ground as to weda pipo die; wen dem die; and di number wey die, afta di govnor Nasir El-Rufai bin release statement on Friday say 66 pipo na im die.

BBC Pidgin bin hear from Ishaya Chinoko, di zonal coordinator of di National Emergency Management Agency NEMA, wey say im no sure say e reach 66 pipo wey die.

As at Sunday morning, even di Kaduna State police command bin no fit confam di tori, but later in di day di Commissioner of Police tok wit tori pipo.

Im say dem don arrest six pipo wey connect wit di killi-killi, and say dem go cari dem go court on Monday.