You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lagos Island Building Collapse: Goment don confirm 20 deaths and 45 survivors
Lagos State Ministry of Health don confirm say na 20 pipo die for di Ita Faaji building wey collapse on Wednesday.
For inside tweet wey Lagos State Emergency Management agency post, dem say 45 pipo survive di building collapse wey primary school been dey.
According to LASEMA, 14 pipo wey include 10 children and 4 adults still dey receive treatment for Lagos Island General Hospital.
Lagos goment don begin demolish buildings for Lagos Island
Earlier for di morning of 15 March, Lagos State goment announce say dem don begin scata buildings wey dem mark for demolition for di Ita-Faaji area for Lagos Island.
Dis dey come after di collapse of di three-storey building for di same area on Wednesday March 13.
Local reports suggest say di authorities been don serve dozens of houses demolition notice before now.
On Thursday afternoon, authorities for Lagos State officially close rescue operation for di site of di collapse