You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lagos Island Building Collapse: Authorities don close rescue operation
Authorities for Lagos South-West Nigeria officially close rescue operation on Thursday afternoon afta dem rescue over 40 pipo from di site of di building collapse for Ita Faaji.
General Manager of di Lagos State Emergency Management Agency Adeshina Tiamiyu wey confam di figure say dem never fit give actual figure of who die yet or who dey di building.
As at on Wednesday, tori be say na like 11 pipo don die.
Tiamiyu also shake head ontop di mata of di plenti crowd wey gada di site wen di incident happun.
"Although we get support from pipo especially di residents I also wan say too many pipo affect di rescue operation and dat one no dey acceptable."
"I no fit give specific number now of di casualty figure since we still dey chook eye but we go issue statement by di end of di day."
"We advise pipo wey dey find dia pipo to go Island General."
Tiamiyu tok say dem carry some pipo go Island General hospital , Igbobi, Gbagada General and Private hospitals.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tiamiyu deny tori say e pass 100 school pikin dem wey dey di building.
"Social media tori of ova 100 pupils no true."
"Di proprietor dey involve for di incident, she no dey stable condition for now."