11 pipo don die (and di number fit increase) for di three storey
building wey fall down.
Authorities
don rescue 40 students from di building collapse.
Eyewitness tell BBC say e pass 80 pikins wey trap inside.
Tori be say for 2017 local authorities bin max dat building for demolition say e no follow wetin law book tok for building mata.
E happun around 10:30am for Ita Faaji area for
Lagos Island local goment, according to Lagos State Emergency Management Agency.
Di building ground floor na shop, di
second floor na pipo domot, while di third floor na school.
Search and rescue operation still dey go on through combined efforts of LASEMA and other emergency responders like Lagos State Ambulance Service, Lagos State Fire Service, Lagos State Building Control Agency, Federal Fire Service.
National Emergency Management Agency, Nigeria Police Force, Rapid Response Squad, Nigeria Security and Civil Defence Corps. Nigeria Red Cross Society, Lagos State Neighborhood and Safety Corps also dey follow help.