Nigeria 2019 Elections: Atiku Abubakar don promise to complete di East West road if im win

Atiku Abubakar

Wia dis foto come from, Twiter/@atiku

58 guvnorship candidate from oda political parties from Rivers State South-South Nigeria don draw body comot from di race declare say dem go vote di Peoples Democratic Party candidates Govnor Nyesom Wike and Atiku Abubakar for di 2019 elections.

89 candidates na im be dey run for govnorship position for di state.

PDP confam di tori during di campaign rally of di presidential candidate Atiku Abubakar for Port Harcourt on Monday.

Meanwhile Atiku don promise to complete di East West road and revive di ports dem wey dey for Niger Delta region if im win di election.

Atiku say evri beta tin wey don happen for Niger Delta happen wen PDP dey power for Obasanjo and Atiku time.

Im come add say di restructuring wey pipo dey find im go do am, "I be di papà of restructuring." Na so im tok.

"I go protect di constitution, I go protect separation of power, I no go interfere with National Assembly, I no go interfere with di judiciary, I no go allow pipo to match di rule of law, I go uphold am." Na so Atiku tok.

PDP rally for Rivers State

Wia dis foto come from, TWITTER/@atiku

Wetin we call dis foto, PDP rally for Rivers State

Atiku say any leader wey wan bring violence with im mouth make dem vote am comot.

Rivers State Governor Nyesom Wike on im own part say di two palava wey dey for Nigeria na darkness and light.

Im say, "APC na darkness, PDP na light. Dictatorship na APC but freedom na PDP. So vote PDP." Na so Wike tok

Oda PDP big pipo follow show for di rally like former President Goodluck Jonathan and im wife and oda guvnors like Sokoto State Govnor Aminu Tambuwal, di PDP Vice Presidential candidate Peter Obi and Atiku

wife, Jennifer Atiku Abubakar.

Davido dey perform for di PDP rally for Rivers state

Wia dis foto come from, Twitter/@atiku

Wetin we call dis foto, Davido dey perform for di PDP rally for Rivers state

Ogbonge artists like Davido and Duncan Mighty follow sing for di rally.