Oshiomole: Why dem boo and stone di APC chairman for dia rally for Ogun state?

Buhari, Amosun and Tinubu

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria president Muhammadu Buhari wit Ogun state govnor Ibikunle Amosun and APC leader Bola Tinubu

Di All Progressive Congress rally for Ogun state, South West Nigeria almost turn anoda tin on Monday as di crowd change am for di APC national chairman Adams Oshiomole stone am wit different objects.

Di gbege start wen Oshiomole mention di name of di party govnorship candidate for di state Dapo Abiodun for im address.

Immediately, di crowd wey gada for di MKO Abiola International Staduim begin boo am, stone am before security come surround am.

Govnor Ibikunle Amosun get to enter poduim to calm di crowd down, but dem no gree hear.

Di Vice President Yemi Osinbajo too climb up to talk to dem, tell dem to calm down, even sing for dem before dem fit calm down small.

Afta den, President Muhammadu Buhari climb stage as some pipo dey hail am Sai Baba, Sai Baba, im tell dem say dem fit vote anybody from any party say na dia choice.

Kasala burst again wen im raise di hand of di APC govnorship candidate again Abiodun as dem start to dey make noise dey throw objects again.

Govnor Amosun candidate na Adekunle Akinlade wey comot APC go form im own party APM afta dem no give am chance for APC.

Wetin come happun be say Akinlade comot APC wit im own supporters go form APM and tori be say na those pipo so na im cause di gbege wey happun for di rally.

Oshiomole as di national chairman of di party get say ontop how di primaries wey announce Abiodun as di candidate waka, so na wetin fit make di APM supporters wey show for di rally para, decide to teach am lesson.