Walter Onnoghen: Buhari break international rule ontop CJN mata - UN top official

Muhammadu Buhari for AU summit for 2016

Wia dis foto come from, Getty Images

One United Nations law official expert Diego Garcia-Sayan don open mouth say di Nigerian president Muhammadu Buihari break international rules wen im recently suspend di kontri former Chief Justice, Walter Onnoghen.

President Muhammadu Buhari suspend Onnoghen last month ontop allegations say di judge no declare im assets.

Di UN sabi pesin wey be di special rapporteur on di independence of judges and lawyers, Diego Garcia-Sayan, tok say dat kain decision suppose come from independent judicial council or a court.

E tok say to just dismiss judges without following legal procedures no gel well-well wit di independence of di judiciary.

On 25 January 2019, order from di president suspend Chief Justice Walter Onnoghen come replace am wit Ibrahim Tanko Mohammad.

Di suspension of di chief justice make international sabi pipo give di president mouth.

As Nigeria number one judge im for fit play important role inside any kwanta wey comot from di weekend elections.

Nigerians dey go election on Saturday, February 16 to vote inside di presidential elections wey go either keep oga Buhari for power or bring in another pesin to rule for at least di next four years.

Oga García-Sayán also fault di recent arrest of one of di senior lawyers wey dey defend Onnoghen, say lawyers work dey important to make sure say justice dey, and dem no suppose ever face threat or prosecution wey no follow wetin recognized joinbodi dem don write down.