Atiku in Kano: Pipo faint as plenti crowd gada for di opposition candidate campaign rally

Atiku Abubakar

Wia dis foto come from, Twitter

Read am in 1 mins

More dan five pipo na im faint as plenti crowd turn-up for di campaign rally of di opposition Peoples Democratic Party presidential candidate, Atiku Abubakar, wey happun for di Sanni Abacha staduim for Kano, North-West Nigeria on Sunday.

Tori also say oda pipo injure as di street of Kano full wit pipo wey wear red cap and clothes even before Atiku show for di venue.

Di red cap pipo belong to di 'Kwankwasiya' movement wey be di group of PDP strongman and former govnor of Kano senator Rabiu Kwankwaso, tori be say dem plenti-well-well and di group popular for Kano.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Meanwhile Atiku wey first branch di Emir, Sanusi Lamido Palace, before im land for di campaign venue address di crowd for like five minutes.

Atiku promise im supporters say im go bring back di economic glory of Kano wen im become president, according to am, Kano level suppose pass as e be now.