Nigeria Elections 2019: Meet 66 year old Kano man wey never vote all im life

Yunusa Idi na 66 years old firewood seller for Kano, north west Nigeria
Wetin we call dis foto, On why im dey regret im actions, Yunusa say e don become more enlightened as many programmes for Radio dey discuss di importance of voting
    • Author, Mansur Abubakar
    • Role, BBC News Pidgin, Kano

"But I no go allow make una show my face because shame dey catch me say at my age, I neva vote for my life before."

Dis na wetin Yunusa Idi wey be 66 years old firewood seller for Kano, north west Nigeria tell BBC News Pidgin.

Yunusa say im na somebodi wey no like wahala for im life, dis na wetin no make am put bodi to go register and join queue to vote for all di elections wey don hold for Nigeria starting from di 1978 elections under military head of state General Olusegun Obasanjo afta e reach 25 years.

"Anything wey go stress my life i no like am, because from time immemorial to vote, procedures dey, you have to go join queue register, then on elections day you go go join another queue to vote and all dis processes fit take you the whole day, I just see am say na wahala."

On why im dey regret im actions, Yunusa say e don become more enlightened as many programmes for Radio dey discuss di importance of voting and tok say if e dey alive e go vote for di first time in di next elections.

"To be honest, I dey regret and shame dey catch me no be small, dis na why I say make una no show my face, e no suppose happen say at my age I neva vote before, na di process wey dey determine good or bad leaders and everybody suppose do am."

Yunusa Idi
Wetin we call dis foto, Yunusa say even im close friends no know say im neva vote before because if dem dey discuss politics e dey chook mouth.

"Dis elections don already late but I promise myself say di next one in four years time I go vote for di first time if I dey alive and I go dey very proud."

"Even my closest friends no know, so na my secret, anytime dem come my place dey discuss politics, I dey chook mouth but dem no know say I neva vote before."