Nigeia Elections 2019: INEC go reject polling agents wey no submit passport, signature

INEC officials.

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 1 mins

Nigeria election office INEC say dem go reject di names of political parties dia agents if dem no meet di expected requirements.

Independent National Electoral Commission INEC dey worry say one week after di deadline for di submission of list of poll agents some political parties never still submit dia own for di general elections.

Dem say even some of di parties wey don try submit names of poll agents dem no even add dia passports and signature.

According to section 45 of Nigeria Electoral Act, political parties suppose appoint polling agent for each polling unit and collation centre for di LGA or Area Council for wia dem get candidate.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Normally, every party wey dey submit di names suppose attach two passports and di pollig agent need sign and submit to di electoral officer at least 14 days before di date fixed for di election.

And INEC say until now, some parties never even send any name not to mention passport.

Dem give dem until di close of business for February 11 to complete di process else dem no go recognise any polling agent wey any party fail to complete di procedure.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

February 16 na im be di date of presidential and National Assembly elections for Nigeria while March 2 na di date for Governorship and State Assembly elections own.