2019 Elections: INEC don release voting procedure for Nigeria

Wia dis foto come from, INEC Situation room
Nigeria election office Independent National Election Commission (INEC) on Thursday tok as tins go take happun once dem step inside polling station to vote for dia candidate on February 16 and March 2, 2019 general election.
INEC release seven steps to follow to helep Naija pipo understand how to voting on election day.
Step one
Once you reach di polling unit make you just join line alias queue den show yoursef to di INEC official. Di official go check if you;
•Dey di correct polling unit
•If di foto for di PVC dey wit your face
If im dey satisfy e go move you to di next official.
Step two
Di second INEC official go check your finger print for card reader to know weda your PVC na authentic. From di card reader im go know if na you true true get di PVC wey you present.
Di card reader contain di name of all di pipo wey register for dat polling station.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Step three
If all correct, from dia you go waka meet di next INEC official wey im work na to confirm say your name and informate dey inside voters register.
If e dey, im go mark your name, give you back your register den put ink for your fingernail.
If im no find your name kwanu for register, you no go vote be dat.
Step four
Once dem put in for your hand, you go move to step four.
Here di next officer go stamp and sign plus put date for di back of your ballot paper.
Im go roll di paper, give am to you den show you di cubicle (dat is to say di box wey INEC build for you to press hand ontop di ballot) wia you go go do your secret vote.
Step five
Once you enta cubicle, put your finger for di ink wey dey dia, den use dat finger wey stain mark di space or box wey dey di ballot paper for di candidate or paety wey you like.
Roll di ballot paper wen you finish.
Step six
Wit your ballot paper jejely waka comot from di cubicle go drop di paper inside ballot box as everibodi dey see you.
Step seven
Now you fit leave di polling unit go house or wait peacefully witout causing any wahala as you wait for di declaration of result.
Dem go past di result of di polling unit dia for di polling unit so dat everibodi fit see am.












