2019 Election: Why I no show face to sign peace agreement wit Buhari - Atiku

Donald Duke, Muhammadu Buhari, Atiku Abubakar, Oby Ezekwesili
Wetin we call dis foto, Pipo bin hail di 2015 Peace Accord say e help maintain peace for di election

Nigeria opposition Peoples Democratic Party don explain why dia Presidential candidate Atiku Abubakar, no show face for di signing of one peace agreement for 2019 presidential candidates for Abuja.

President Muhammadu Buhari bin dey di International Conference Centre to join oda candidates sign di peace agreement, wey di National Peace Committee write.

According to Media Adviser to Atiku, Paul Ibe, di former Vice Presido no receive any formal invitation to show for di signing of di Peace Pact.

Although Rev Fr Matthew Kukah wey be part of di organisers, tell BBC Pidgin say dem invite all di candidates, PDP say dem no know wetin happun and dem go chook eye to find out where di communication gap come from.

Inside statement dem release, di party also use di oppourtunity to reassure Nigerians say dem dey commited to peaceful election for di kontri for 2019.

"Dem know our presidential candidate all over di world as global ambassador of peace, who go always support tins wey go move peace forward for di kontri and all ova di world."

"We go visit di office of di National Peace Committee to chook eye inside di peace document and do everitin dem require from us ontop di peace accord for di 2019 elections." Na so di party tok.

Former Nigerian military ruler Abdulsalami Abubakar na im be di chairmo of di committee wey dey organise di signing.

Dis na di second time wey organisers dey make presidential candidates sign di agreement, and oga Abubakar say make all di candidates ensure say dem promote peace and violence free election.