INEC PVC: Nigeria Elections office don shift voters card collection deadline

Wia dis foto come from, INEC NIGERIA/FACEBOOK
Nigeria election office - Independent National Electoral Commission (INEC) on Friday postpone di deadline for di collection of Permanent Voters Card (PVC) by three days.
Di deadline wey suppose be Friday, 8 February, 2019 go now extend to Monday, 11 February, 2019, according to INEC Chairmo, Prof. Mahmood Yakubu.
Prof Yakubu make di announcement inside meeting wey im follow do with Resident Electoral Commissioners on Thursday.
INEC say e go include Saturday and Sunday from 9am to 6pm.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
PVC na wetin all voters need to get for hand before dem fit cast vote for di upcoming general elections for Nigeria.
Dis no be first time wey INEC don extend di deadline to collect PVC - di original deadline suppose be 21 January 2019, but dem later change am wen di election joinbodi see say many pipo neva collect.
Di card get di full name, foto, and information of di owner and di way dem don do am, pesin no fit use anoda pesin PVC take vote.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2






