Ghana CID Officer help make I escape from police custody – Suspected Nigerian kidnapper

Wia dis foto come from, Olivia Adiku/Takoradi Police
Nigerian suspect wey Ghana police arrest am in connection to kidnapping of some three girls for Takoradi say one CID Officer help am escape from police custody.
Di suspect, Samuel Udoetek-Wills talk di Takoradi District Court say although he no know di CID Officer en name, he go fit identify am by face.
He also reveal say another guy who dem dey call Kwesi, provide am plus oil which he take cut di iron bars for di cell windows where he escape pass.
Presiding Judge, Michael Kudjo Ampadu adjourn di case go February 18, 2019 make di suspected kidnapper bring en witness, Kwesi, who go confirm di claim say police help am escape.
Early dis year, Ghana Police re-arrest di suspected Nigerian wey he escape from police custody for Takoradi Central Police station under di watch of seven officers.
Later dem re-arrest di suspect wey dem charge am plus escape from lawful custody, destruction of public property, resisting re-arrest den kidnapping.








