Foreign Direct Investment: How Ghana overtake Nigeria as largest FDI recipient for West Africa

Wia dis foto come from, Nana Akufo-Addo
- Author, Favour Nunoo
- Role, BBC News Pidgin, Ghana
Ghana authorities say dem embark on aggressive "brand Ghana" marketing campaign which dey highlight di political stability den positive business climate.
Dat be how Ghana overtake Nigeria as di largest recipient of Foreign Direct Investment for 2018, according to new United Nations Conference on Trade and Development (UNCTAD).
Ghana Investments Promotions Authority (GIPC), CEO, Yoofi Grant talk BBC Pidgin say "we establish clear pathway to growth plus wana macro-economic policies."
"We make sure say wanna economy dey inspire trust den confidence inside investor…we want make Ghana attractive destination for West Africa so wanna hub strategy dey attract more investments." Mr Grant tok.

Wia dis foto come from, Nana Akufo-Addo
Di report which dey monitor global investments trends reveal say Ghana secure $3.3 billion, compared to dema Nigerian counterparts who record 36% percent decline in FDI plus $2.2billion dollars.
Di oga of Ghana Investments Promotions Authority reveal say President Na Akufo-Addo also dey tell di story of Ghana give foreign nations.

Wia dis foto come from, Ken Ofori Atta/Facebook
President Akufo-Addo en Ghana Beyond Aid agenda dey help di kontri pursue more investments for now, which later government go turn am into trade.
According to Mr Grant, GIPC too dey pursue aggressive "brand Ghana" campaign which dey make di kontri attractive destination sake of dem dey market di political stability, business friendly policy framework den other things give investors.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Nana Akufo-Addo
Meanwhile, Egypt record di highest FDI investment for Africa, dem move from $7.4billion to $7.9billion investments for areas like real estate, food processing, oil and gas den renewable energy.
Foreign Direct Investments be investments wey companies or individuals dey put inside other countries.
YOU FIT LIKE DIS BBC SPECIAL TORI:













