You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
ASUU Strike: Nigeria public university lecturers don suspend strike
Read am in 1 mins
Nigeria public university lecturers don suspend di strike wey start since 4 November, according to reports.
Dem suspend am afta dia meeting wit goment on Thursday evening.
Di Academic Staff Union of Universities announce for dia Twitter handle say schoolwork go open on Friday, 8 February, 2019.
Nigeria Federal Ministry of Labour say dem don reach agreement wit di lecturers.
But ASUU say di condition to end di strike na for goment to fulfil dia own part of di agreement.
We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.