You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Vice Presidential Debate as e bin happun

The Peoples Debate na collabo wey BBC, TVC, BudgiT, One, EnoughIsEnough and Transition Monitoring Group join bodi organise.

Live Coverage

Onyinye Chime

  1. Una bye bye

    Na here we gba break for The Peoples debate. We don tell una di tins wey di candidates tok, post correct foto plus share some ogbonge quotes from di candidates.

    As we hang boot we say una bye bye.

  2. Debate don finish

    And now di debate The Peoples vice presidential debate don finish.

  3. Rabiu don tok wetin e go do for health care

    We go employ 160 k health personnel to work for di 777 local goment for di kontri.

    Evenb as di kweshion bin come on top wetin e go do for health even as doctors dey comot.

  4. Nigeria health sector - ANN

    ANN say dem go make sure say evribodi get National Health Insurance Scheme (NHIS). Dem go also allocate ten percent for di budget to health. Khadihjah also say, dem go encourage doctors and oda health personnel to treat pipo for community.

  5. Candidates dey ansa kwesions ontop bodi mata

  6. AAC candidate ontop Education mata

  7. ANN candidate ontop Education

  8. Education nko wia we dey? - ADP

    As par education, Martin say dem go change di education system, encourage research.

    According to am, di koko be say di goment wey dey now no send education. As e dey now, pipo wey suppose dey school for four years dey dey school for 7 years

  9. Candidates go begin ansa kwesions ontop Education Mata

    Na di ADP candidate dey ansa di first kwesion.

  10. Join di debate online

    Make you sef tok your own. Join di debate, comment, ask kweshion. Use BBCNigeria2019, #NigeriaDecides and #ThePeoplesDebate2019.

  11. Wetin di ADP candidate tok as par Nigeria debt mata

  12. Still for economy - ADP

    As architect, Martins say, dem go develope di kontri infrastructure like roads and produce solar system. Di ADP Candidate say dem go also generate plenti money from di airport because of di location.

    Im also say, "If you no punish thief e go do am again."

  13. About economy - AAC

    Rabiu say dem go turn Nigeria into conmstruction site plus give 5 million pipo jobs.

    Dem go employ 160,000 health workers and 200,000 teachers for each local govment. Im say dis one nobe trader moni.

  14. About economy - ADP

  15. About economy ANN VP Candidate

    Khadijah say dem go put economic zone for di political zones.

    And dem go ensure and strengthen SON and NAFDC and make sure say dem regulate all di product wey we dey produce.

  16. Economy Mata na im dey dey yan

    Candidates dey ontop evri-evri ontop minimum wage.

  17. On top Security - ANN

    Khadija say dem go secure Nigeria border.

  18. Join di debate for social media

    Use di hashtag #BBCNigeria2019, #NigeriaDecides and #ThePeoplesDebate2019 to drop your kweshion or send your comment.

  19. Africa Democratic Party Vice Presidential Candidate ansa to security mata

    Durolagbege Martins na di number three vice presidential candidate, im dey represent Africa Democratic Party (ADP).

    E say leadership na big problem and need dey to revamp do security sector and sack the soldiers dem wey work for both Buhari and Jonathan

  20. On top security mata - AAC

    Rabiu of AAC, say Nigerian Problem na leadership. And di only wayto change di kontri na to change di leadership system for di kontri.

    Both goment of Buhari and Jonathan no send on top security mata. He say e go sack military chief wey no dey do well and change di structure of Nigeria military.

    He say di party main agenda na to promote and solve di problem of security, power, corruption, health.