You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

BBC Governorship Debate for Delta State: Live updates as e happun

Candidates ansa kweshion about dia policies and how dem wan take move Delta State forward.

Live Coverage

Fiona Equere

  1. Final goodbye for today

    Na for here we go march brake for today live page update wia we don tell una some of di tins wey di candidates tok.

    Tuale to everybodi wey join us.

  2. Vice Presidential Debate go happpun by 7pm

    Later today we dey organize #ThePeoplesDebate wia five vice presidential candidate go argue why na dem suppose win di 16 February general election.

    Use #BBCNigeria2019, #NigeriaDecides and #ThePeoplesDebate to follow di debate.

    l

  3. Thank you to evribodi wey join us today, We throway salute!

    We also thank Odiakpo Obire Progressive People's Allaince, Brando Omu All Grand Allaince Party candidate and Frank Ufuoma Esanubi African Action Congress (wey join us today).

    Di BBC Governorship Debate for Delta State na di third debate wey BBC Pidgin organise.

    Di three candidates wey show tok wetin dem get for mind to move di state forward.

    Dem also ansa kwesions from di audience dem.

    But di tok-tok around wetin go make Delta State beta neva end. Join us on social media with hashtag #BBCGovDebate and #BBCPidginDebate.

  4. Oga Frank Ufuoma Esanubi of African Action Congress say dis election na election about out future not about our past. No sell you vote for N1000, N2000 no go solve our problem.

  5. Chief Brando Omu AGAP candidate say If una belief say e don do, time to make positive change don reach, our goment go improve ICT, infrastructure, health, improve public school cos my pikin and my cabinet members pikins go dey public school.

  6. Final tok from di candidates dem

    Oga Odiakpo Obire PPA Candidate say vote for credibility and integrity. We no get godfathers so no wan go mortgage una future.

  7. Di audience ready come..., Qweshion time

  8. Security mata nko?

    Odiakpo Obire of PPA say if man no get work anytime e see e go do. dis mata na because work no dey If dem get beta work e go reduce security palava and if we improve on intelligence gathering e go help

    Frank Ufuoma Esanubi of AAC say AAC We go change tins. Within 3 months we go make emergency number Install CCTV and make am compulsory.

  9. Candidates dem wey no show, We bin invite six govnorship candidates dem

    Na only three turn-up.

    More about dat tori here

  10. Wetin di candidate tok on employment mata:

    We go open small scale business for our youths dat na wetin Odiakpo Obire of Progressive People's Allaince tok.

    Im also say im go give dem money to start

    Frank Ufuoma Esanubi of AAC say im go hammer every graduate wey finish university or polytechnic afta dem finish NYSC wit N1m.

    We don do research and we see say na N20billion we go need to do dis one. Na so im tok

  11. You fit watch di debate as e dey happun for our platforms

    Ontop our website for www.bbc.com/pidgin

    Facebook Instagram and Twitter on @BBCNewsPidgin

  12. Di candidates wey dey ground

    See di candidates wey show for di BBC Guvnorship debate for Delta State

  13. Dem don start

  14. Join di debate ontop social media

    Use di hashtag #BBCGovDebate and #BBCPidginDebate to follow di conversation and to ask di candidates dem your qweshion.

  15. Stay wit dis Live page to get ogbonge updates on how di debate dey go – as e dey hot!