Nigeria election 2019: Appeal Court say make everibodi match break ontop Rivers APC mata

Wia dis foto come from, Tonye Cole
Court of Appeal wey dey for Port Harcourt, di capital of Rivers State say make everibodi match break ontop di decision of High Court, wey say make election bodi INEC no put di names of all candidates of di All Progressives Congress ontop ballot paper.
Di Court of Appeal give wetin dem call stay of execution ontop di judgement of di Federal High Court (FHC) wey bin cancel all di primaries of di All Progressives Congress for Rivers State.
Dat wan make INEC to remove di names of di party candidates di elections.
Wit dis Appeal Court judgement now, e mean say di name of Tonye Cole wey be di govnorship candidate, and odas fit enta di ballot papers for different election dem again.






