Nigeria Elections 2019: INEC final list of govnorship candidates for Nigeria 2019 election don land

Magnus Abe/Tonye Cole

Wia dis foto come from, Magnus Abe/Tonye Cole Facebook

Wetin we call dis foto, Magnus Abe and Tonye Cole dey drag APC govnorship ticket for di oil-rich Rivers State

Nigeria election join bodi - Independent National Electoral Commission (INEC) don publish list of State Governorship and House of Assembly Candidates wey voters fit vote on 2nd March for most states across di kontri.

For Rivers State di names of di candidates of Nigeria ruling All Progressives congress (APC) party no dey dia for di list.

On 7th January, one Federal High Court for Port Harcourt, Rivers State draw ear give election bodi INEC, say make dem no recognise any candidate of di All Progressives Congress (APC ) for di 2019 General elections for di state .

Di court also cancel all nominations wey APC get for Rivers State as e concern di 2019 elections.

Di court make am clear say APC no go follow do govnorship, Senate, House of Representatives and House of Assembly elections during di 2019 election for Rivers State.

Rivers State governorship candidate list
Wetin we call dis foto, Rivers State governorship candidate list
Rivers State governorship candidate list
Wetin we call dis foto, Rivers State governorship candidate list
Rivers State governorship candidate list
Wetin we call dis foto, Rivers State governorship candidate list

Some Appeal case wey APC get suppose come up for court on di 30 January 2019 but gbege happun for di Court of Appeal Port Harcourt wen dem go for di case.

Tori be say NBA Port Harcourt members bin go make sure say evri bodi follow di two day strike wey di Nigerian Bar Association declare to protest di way wey federal goment suspend and carry di Chief Justice of Nigeria Walter Onnoghen go court on top Code of Conduct matter as im no declare im assets.

So for di day two of di strike Chairman NBA Port Harcourt and oda members go make sure no court seat, na im dem come clash wit di APC lawyers sotay dem beat up di NBA Port Harcourt Chairman Sylvester Adaka.

Justice A. A. Gumel wey be di head of di three man Appeal panel come adjourn di case wey Tonye Cole and Magnus Abe dey appeal against di order make INEC no recognise any APC candidate and di one wey concern Tonye Cole vs Magnus Abe to 5 February.

While di case between APC vs Magnus Abe, di court adjourn am go 4 February but di court strike out di appeal by Tonye Cole and odas against INEC and Magnus Abe say na 'miscellaneous application.