National Bureau of Statistics say unemployment don increase for Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images
Information wey di National Bureau of Statistics release show say e pass 4,000 PhD holders for Nigeria wey dey find work but no fit see.
For di data wey dem release on Wednesday, e show say 13.6% of those wey dey find work get doctorate degree, while 14.8% of those wey get PhD dey do work wey dem qualify pass to do.
Di National Bureau of Statistics say di total number of pipo wey be unemployed, wey be say dem no do any work at all, increase from 17.6 million for 2017 to 20.9 million for 2018. But dem say dis 20.9 million do some kain work, compre to di 9.7 million pipo wey no do any work at all at all.
You fit read di full report here.

Wia dis foto come from, NBS
Dem break am down say unemployment increase from 18.8% for Q3 2017 to Q3 23.1% for 2018.

Wia dis foto come from, NBS









