NLC strike: How labour unions gbege fit affect you

Bus conductor

Wia dis foto come from, Nduka Orjinmo/BBC

Wetin we call dis foto, Transport moni fit go up from Thursday

Di Nigerian Labour Congress and Trade Union Congress don announce say dem dey start strike on Thursday till thy kingdom come.

Labour bin do meeting wit di Minister of Labour and Employment, Chris Ngige, for Abuja on Wednesday, but noting come out of am.

Di strike na for goment to increase di minimum wage and di Trade Union Congress (TUC) General Secretary Musa-Lawal Ozigi bin advise pipo make dem pack dia house with evritin wey dem need for as long as di strike last.

Most of di unions wey dey for dis congress dem dey do services wey many Nigerians dey use and many many pipo go feel di strike ne way or anoda.

Fuel Scarcity

pesin get gallon of fuel for hand wan put am for motor

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Black market dey common for Nigeria wen fuel begin scarce

Di Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG) and di Petroleum and Natural Gas Senior Staff Association of Nigeria (PENGASSAN) na strong members of TUC and go join for di strike from Thursday.

Na dis unions dey move petrol products for di kontri and dis one go cause shortage of fuel because e go reduce di transportation of di products enta filling station.

Health Services

Student doctors start to dey attend to patients
Wetin we call dis foto, Di last time health workers strike, tins bin bad sotey na student doctors start to dey attend to patients so tins no go spoil finish

Pipo wey dey hospital go suffer wella on top dis strike as e go affect doctors wey go also join for di strike.

Dis na as di National Association of Community Health Practitioners of Nigeria (NACHPN), and Nigerian Union of Allied Health Professions (NUAHP) dey part of di TUC and National Association of Nigeria Nurses and Midwives (NANNM) dey part of di NLC so dem go join di strike action wey go make work hard for hospital.

Di last time health workers strike, tins bin bad sotey na student doctors start to dey attend to patients so tins no go spoil finish.

Transportation

Pipo dey waka for traffic
Wetin we call dis foto, Transport to move around go hard

Di National Union of Road Transport Workers (NURTW) go surely enta for dis strike, so movement wit public transport go be wahala.

No forget say fuel scarcity dey for front so dat one go also affect how waka go be for pipo wey must compulsory go work dis period.

Transport money go go up as fuel go begin scarce.

Dis transport mata go affect flights as National Association of Aircraft Pilots and Engineers (NAAPE) dey part of di TUC.

Food

aerial view of market

Wia dis foto come from, Getty Images

As transportation dey match break, wetin go follow na food items wey need dis means of transportation to reach di hand of di consumer.

So depending on wen di strike last reach e fit affect dat one.

And market pipo no fit open shop as di Nigeria Union of Local Government Employees (NULGE) go run with NLC for di strike and dem dey part of pipo wey dey organise market for goment.

Education

Pipo gada for front of University building

Wia dis foto come from, other

Di Academic Staff Union of Universities don threaten say dem sef go enta for dis strike because dem dey part pf di NLC as well as di Non Academic Staff of Universities Union.

Dis one mean say university students fit see demself dey siddon for house.