You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Atiku: Nigerians dey react to di former vice-presido plan to make Nigeria work again
Many Nigerians don dey tok dia mind ontop how dem see former Vice Presido wey be di main opposition presidential candidate, Atiku Abubakar plan to make Nigeria work again if im become president.
Dis one na afta di Peoples Democratic Party - PDP candidate launch how im go sell im market on Monday.
Atiku tok say e go attract investment and support all di small and chikini business dem wey dey for Nigeria.
Di plan be say dat one go increase Nigeria Gross Domestic Product by 2025 to 900 million dollars.
E also tok say di support on small and chikini business go create at least 2.5 million jobs per yeat and dat one go comot at 50 million pipo from poverty in two years.
Na inside live broadcast for im official Facebook page Atiku tok im plan and e no tay before pipo start to tok dia mind too.
Atiku Abubakar wey don be vice president before tok say e go start Apprenticeship Programme wey go fit give Oga boss for artisans back bone so dat dem go fit train about one million apprentice dem everi year.
E tok say e wan restructure Nigeria so dat everi state go fit make more money from inside dem state but e no go affect di funding di federal goment go dey give states.
End of Di one wey oda users dey read well well
Basically, e tok say e want di kontri wey work for one orphan for Adamawa to work for evribodi.