Nigeria 2019 election: How much politicians fit spend for campaigns

How much politicians fit spend for 2019 election campaigns na di big kwesion as politicians begin gada money to sell dia market
One organization wey dey torchlight election campaigns for Nigeria say Nigerian politicians sabi over spend pass wetin di law tok during election campaigns.
Section 91 of Nigeria electoral act wey lawmakers amend for October 2018 want make presidents no spend pass 5 billion naira from 1 billion naira wey di 2010 Electoral law tok and make National Assembly candidates no spend pass 70 million naira from di 20 million naira wey di old election law tok.
Di cost of living for Nigeria and di way pipo dey over expect from politicians dey always make election campaigns dey expensive for Nigeria, according to one woman National Assembly candidate wey tok to BBC News Pidgin.
Samson Itodo, di executive director of YIAGA Africa tell BBC Pidgin say dis one wey election campaign don start so, na money politics go be di order of di day.
President Muhammadu Buhari as at Monday neva sign di section 91 of Nigeria electoral act wey lawmakers amend for October 2018.

Wia dis foto come from, SAMSON ITODO
Politicians dey over look campaign spending limits because agencies wey suppose torchlight di mata like INEC -wey be Nigeria election office no dey hold dem accountable, Samson Ito add.
Monday na di first working day for presidential and national assembly candidates to begin campaigns all over Nigeria.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di market Nigeria president Muhammadu Buhari dey sell for second term election na Next Level e call am while di main opposition presidential candidate Atiku Abubakar of Peoples Democratic Party - PDP also dey sell Atiku Plan.
"For instance, to campaign for my federal constituency I go need at least two second hand Hiace bus, print posters and billboards for at least each ward to do my campaigns, wetin I don tok alone go cost nearly 20 million Naira" Victoria Nyeche, di APC Candidate for Port Harcourt Federal Constituency One tok.

Wia dis foto come from, Victoria Nyeche
Nyeche say dat no follow for kola wey as culture demand you go give community wen you wan gada dem to do campaign, "so you see sey election campaign reality dey expensive pass di 20 million naira wey di law tok for Nigeria.
Tori be say INEC don dey train man power for dis area to limit di role money dey play inside electoral politics for Nigeria.
YIAGA Africa also believe say di spending limit inside di 2010 Electoral Act no respond to economic realities na make di National Assembly for October try to increase di spend money join di electoral amendment pass give di President to press hand sign.











