NLC strike: Labour don suspend nationwide strike

Labour Congress

Wia dis foto come from, STRINGER

After plenti meeting for Monday night for Abuja, Ayuba Wabba, President of the Nigeria Labour Congress, NLC, don announce say di strike wey dem plan for Tuesday no dey go ahead again.

Wabba talk say dem no dey do di strike again sake of say dem don agree wit govment committee on top wetin go bi di new minimum wage for Nigeria.

Im talk say di committee go submit wetin dem agree to President Muhammadu Buhari on Tuesday and na afta dat one dem go come announce di new minimum wage.

Before dis one, labour leaders first think say di strike go happun. Dem tell BBC Pidgin say e be like say govment no dey sincere wit dem.

Dem say goment pipo just dey call governors to beg dem to increase dia on side of di bargain and dat di way dem dey behave, e show say dem no ready to shake body.

Wetin we call dis Video, ASUU don stop work till-thy-kingdom come for Nigeria

Before dat one, leaders of organised labour on Sunday true-true shun di last minute meeting wey goment arrange to take settle di minimum wage wahala.

Nigeria Minister of Labour and Productivity, Chris Ngige, bin say di meeting suppose hold around 6pm for di office of di Secretary General Secretary General of di Federation, but wen time reach, na only goment pipo dey available.

Labour oga dem bin don tok say dem no go attend di meeting sake of say goment no serious to chook eye for workers welfare.

Labour dey demand say make goment increase minimum wage from N18000 to N30,000 but goment say im fit pay only N24,000 while state goment say dem go pay N22,500.

Di Secretary General of di Federation, Boss Mustapha say di reconciliation meeting na to harmonise di 5th chapter of di tripartite report so dat all of dem fit agree for di figure wey dem go put for di report before dem submit am to President Muhammadu Buhari.

E say e no make sense at all if dem agree on moni and those wey suppose pay no fit pay di workers. E explain give say about 27 states neva fit pay di 18,000 to dia workers.