APC primaries: Rochas Okorocha son-in-law, three states own don cancel

Uche Nwosu

Wia dis foto come from, Uche Nwosu

Wetin we call dis foto, Uche Nwosu

Eyes go focus on Imo State for south east Nigeria, wia di ruling All Progressives Congress (APC) dey do primaries.

Uche Nwosu wey be di son-in-law of di current govnor Rochas Okorocha dey dig am out wit odas, wey include Hope Uzodimma.

Dis Uche Nwosu na im Govnor Rochas want to replace am wen im tenure expire next year.

Di National Working Committee of di APC bin don shift di govnorship primaries for Lagos, Enugu and Adamawa states.

Dem also change how dem go take do di primaries for Enugu and Adamawa states from indirect to direct primaries.

APC primaries
Wetin we call dis foto, For Port Harcourt, na two winners come out of di different groups wey do primaries

On Sunday for Lagos, leader of di All Progressives Congress Party for Nigeria, Bola Tinubu say Lagos State govnor Akinwunmi Ambode no dey follow di master plan wey dem set, to develop di state.

Tinubu wey say im go vote for di party primaries wey go happun on Monday 1 October, say im no go support di govnor for di election.

For statement wey im sign by imself, di former govnor of di state wey many pipo see as 'Govnormaker' for Lagos politics, say im no sabi why di present goment no follow di master-plan.

"We must vote to return Lagos to beta way, so dat everibodi fit enjoy good prosperity", im tok.

Di state govnor Akinwunmi Ambode bin don first tok say di pesin wey dem wan use replace am, no qualify to be govnor.