Mama Taraba, oga Buhari Former Minister for Women Affairs don use vex resign APC, join tear rubber party

Mama Taraba don tell president Buhari bye-bye, i no work again

Wia dis foto come from, Senator Jummai Alhassan

Wetin we call dis foto, Mama Taraba don tell president Buhari bye-bye, i no work again
Read am in 2 mins

Former Nigeria Women Affairs Minister, Aisha Jummai Alhassan don join tear rubber political party di United Democratic Party (UDP) afta she use vex comot di ruling All Progressives Congress (APC).

She cari yan go Twitter say, she plus seven state assembly members, local and state goment executives plus odas don pack dia load go UDP.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Alhassan resign as goment minister and member of APC for early morn morn today wit letter she write to her oga President Muhammadu Buhari.

Why Mama Taraba resign

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Presido Buhari bin appoint Madam Alhassan, wey pipo dey call Mama Taraba, for 2015.

For di letter wey she write go give Presido Buhari on September 29, Mama Taraba complain say APC national working committee no give her any beta reason why dem disqualify her not to contest for 2019 govnorship election inside Taraba State.

Mama Taraba letter

Wia dis foto come from, @SenAishaAlhassn

Wetin we call dis foto, Mama Taraba say she don kawa comot office as minister and APC member
Mama Taraba letter

Wia dis foto come from, @SenAishaAlhassn

Wetin we call dis foto, Mama Taraba say APC no tell her why dem disqualify her not to contest govnor seat for Taraba
Mama Taraba Letter

Wia dis foto come from, @SenAishaAlhassn

Wetin we call dis foto, Mama Taraba wish president Buhari good health and thank am for di opportunity wey im give her to serve

Madam Alhassan claim say dis na big injustice against her afta she don buy di form finish and don be loyal member of di party since 2014.

She say sake of dis ojoro wey dem do her, she decide to resign as e be say since dem say she nor qualify to contest, then she no still qualify to remain as APC member and as minister.

Mama Taraba bin buy APC form to contest but dem disqualify am

Wia dis foto come from, @SenAishaAlhassn

Wetin we call dis foto, Mama Taraba bin buy APC form to contest but dem disqualify am

Dis resign dey come afta APC screen her comot not to join those wey wan contest dia party govnorship primaries wey dem wan do September 30.

E get one time wey pipo surprise for Mama Taraba as she tok for public say she dey loyal to former Vice President Atiku Abubakar.