Adebayo Shittu: APC don block minister wey 'dodge' NYSC and Mama Taraba to be govnor

AdebayoShittu

Wia dis foto come from, @HMAdebayoShittu

Wetin we call dis foto, Minster of Communication Adebayo Shittu

Nigeria ruling All Progressives Congress (APC) party don say mba, no, to two of dia ministers wey wan contest as govnors for dia states.

Di Minister of Women Affairs, Aisha Alhassan, AKA Mama Taraba and Minister of Communication, Adebayo Shittu, na dem di screening committee of APC block.

Madam Alhassan wan govern Taraba State as APC candidate, while oga Shittu wan govern Oyo State.

Dem disqualify oga Shittu say im no do National Youth Service Corps (NYSC) but dem no give reason why dem say no to madam Alhassan. E fit be becos she dey close to Alhaji Atiku Abubakar, wey don port go di opposition People's Democratic Party. She bin pledge her loyalty to am, wen im bin comot di party.

APC, tok-tok pesin Yekini Nabena, na im release di list of all di pipo wey di party don clear to contest di party primaries, wey dem don move to Sunday 30 September.