Osun rerun election: INEC don confam Gboyega Oyetola of APC as govnor-elect

Di Independent National Electoral Commission (INEC) don announce say na Gboyega Oyetola of di All Progressives Congress (APC), win di Osun state govnorship election.
INEC say Oyetola defeat Senator Ademola Adeleke, candidate for di People's Democratic Party (PDP) wit 482 votes afta im score 255,505 votes over Adeleke 255,023 votes afta dem do rerun election for Thursday.
President Muhammadu Buhari don congratulate di winner, im party man, while di candidate of di People's Democratic Party Senator Ademola Adeleke say im dey go election tribunal as im no gree say im lose di election.
How Thursday election take waka for Osun State
Many pipo get dia own version of how tins take happun for Osun State.
Di day bin start wit accuse say security pipo and thugs, no allow election observers and tori pipo to near polling stations, wey make INEC to announce for twitter:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Anoda accuse wey follow join di Thursday election na say thugs amd oda jaguda pipo, no allow supporters of some political parties vote.
Some pipo for twitter even tok say one party use white handkerchief as sign to take know who be dia party supporter so as to allow only some pipo vote.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Oga for Osun state PDP don already reject any kain result wey INEC go bring come. Hon. Soji Adagunodo don tok say di Osun rerun govnorship election na attack on democracy and di biggest tiff-tiff wey don happun for di south west state for Nigeria on Thursday.
End of Di one wey oda users dey read well well
Kola Ologbondinyan, wey be national tok tok pesin for PDP, for Thursday morning tok say make dem cancel di election unto say na electoral wayo.
Na for Twitter im cari put dis informate.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
INEC bin declare say di election wey dem do for Saturday, 22 September dey inconclusive afta di returning officer Professor Adeola Afuwape announce say PDP get 254, 698 votes while di candidate of di APC party get 254, 345 votes.
INEC say di rerun dey important well-well sake of say di vote gap between PDP and APC (353 votes) dey less than di number of registered voters wey be 3,498 for di seven polling units wia dem cancel election because of disturbance or technical palava.
INEC come fix Thursday 27 September wey dem go do rerun elections for seven polling units inside four local goment for Osogbo, Orolu, Ife South and Ife North local goment.












