Osun Election 2018: Senator Iyiola Omisore and im SDP go join bodi wit APC for Osun repeat elections

Senator Iyiola Omisore don tok say im Social Democratic Party (SDP) go join bodi wit di ruling All Progressive Congress (APC) for di repeat of di Osun state elections wey go happun for Thursday, 27 September.
Omisore na candidate of SDP for last weekend election for di south west state of Nigeria and as e dey so, im dey third position for result wey Nigeria election authorities tok say dey 'inconclusive''.
Omisore tok say from beginning im don ready to partner any party wey dey ready to work wit di SDP to achieve e agenda wen dem enta goment.
SDP present di koko of dia agenda to di two main parties for Osun state - APC and People's Democratic Party (PDP) - wey include;
- Goment workers' welfare
- Payment of moni wey goment owe civil servants in di first three months of dia tear rubber tenure
- Development projects wey goment go do for evri part of di state must dey equal
- Development projects wey dem go do for di state, Osun pipo go dey involved
- Traditional rulers for di state go get mouth to chook inside goment agenda

Omisore say na APC agree to di conditions and dat na di reason why di SDP don gree to join bodi wit di ruling party.
Nigeria election bodi, di Independent National Electoral Commission (INEC) order repeat election afta dem tok say di result of last weekend elections dey 'inconclusive', wey mean say no clear winner dey.
Na only 353 votes take separate PDP and APC and since INEC bin cancel almost 4,000 votes for some polling centres dem tok say e fit affect di final result.
Na only APC and PDP go dey for di ballot for di repeat election.
End of Di one wey oda users dey read well well











