Osun election: Omisore say wetin mata pass na progress of Osun State

Saraki and Omisore for Ile-Ife
Wetin we call dis foto, Omisore bin dey PDP before im comot go SDP
Read am in 1 mins

Di candidate of di Social Democratic Party for di Osun State govnorship election, Senator Iyiola Omisore, say im never decide who im go support but wetin important pass na progress of Osun State.

Im tok dis one afta PDP presidential candidate, Senator Bukola Saraki, come visit am for im house for Ile-Ife on Monday.

Omisore say as di two parties (PDP and APC) go enta di same trousers for di rerun of di Osun State govnorship election on Thursday 27 September, im don decide to support whichever of di party wey get di same idea of good governance wey im own party (SDP) get.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Saraki ontop im social media account say im and Omisore gree to work togeda because di two of dem want di same tin. Dat one na good governance for Osun State.

"Over di next 24 hours, we go siddon plan how dis go happun," Saraki tok on Twitter.