Osun election 2018: Jaguda pipo don attack PDP chieftain for Osogbo

PDP chieftain, Fatai Diekola, car afta di attack as police dey carri am comot
Wetin we call dis foto, Dis na PDP chieftain Fatai Diekola car afta di attack as police dey carri am comot

Thugs wey some pipo claim say dey loyal to di ruling All Progressive Congress APC) party for Osun State on Monday, don attack one Peoples Democratic Party (PDP) chieftain, Fatai Diekola for Osogbo, south west Nigeria.

Di attack on Diekola and im followers begin when dem go house to house campaign for one area wia some APC loyalist don dey.

"Na when dem try dey counter one anoda, di whole gbege start" tok one resident wey no want make im name comot.

"For di first time in my life, I see pipo, young pipo dey comot gun and dangerous weapons".

Just as di gbege start, pipo begin close dia shop and house, as fear catch those wey dey live for dat community so tey dem no fit follow BBC News tok about di mata.

Di pipo say dis na because "di jaguda pipo still fit dey around and nobody wan die anyhow death because of dis politicians".

Gun cartridge wey fall for ground during di gbege
Wetin we call dis foto, Gun cartridge wey fall for ground during di gbege

Fatai Diekola bin dey APC until 2017 when im cross go PDP. Many pipo for Osun Diekola as one important pesin wey im porting change di way politics be for Osogbo, Osun State capital, not to favour di ruling party.

As at di time we dey do dis report, di hospital wey dem carri Diekola go don get security for safety reasons.

Some residents also accuse officers of di Nigeria Security and Civil Defence Corps, say dem get hand for di gbege. According to dem, di NSCDC officials dey dia when di attack happun.

We still dey try reach NSCDC to confam dia side of di tori.