Osun election 2018: ''Senator Ademola Adeleke na im win di election'' - PDP

Adeleke

Wia dis foto come from, Twitter/@IsiakaAdeleke1

Wetin we call dis foto, Senator Ademola Adeleke
Read am in 2 mins

Di People's Democratic Party (PDP) wey be di main opposition party for di Osun state govnorshop election don tok say dem reject di ''inconclusive'' result wey di Independent National Electoral Commission (INEC) announce for di Saturday election.

PDP say make INEC declare dia candidate Senator Ademola Adeleke as di real winner.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Na for social media, PDP cari dis tori keep.

Dem say di election na straightforward somtin and since oga Adeleke na im votes plenti pass so e follow constitution make im become govnor-elect shaperly.

PDP add put say dem dey sure di ruling All Progressive Congress (APC) party dey try control INEC so dem fit use wuruwuru run tins.

Lai Mohammed

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Information minister Lai Mohammed

APC cause Osun state election result to dey 'inconclusive' - Lai Mohammed

Meanwhile Nigeria minister of information Lai Mohammed tok say APC agree wit di result.

Oga Lai tell BBC say APC cari blame for di result of sake of say dem dey use small eye look opposition parties.

Lai Mohammed tok say, ''We agree wit di result wey INEC announce. APC for Osun state no try unto say dem relax for PDP, dem cari too much confidence for head but we dey ready for di next stage''.

Im still tok say dis result no mean any tin for 2019 general election sake of say APC dey wait opposition parties wit fresh strategies.

Osun state elections

Alhaji Gobyega Oyetola wey be candidate for APC score 254,345 votes but na Senator Ademola Adeleke wey cari di People's Democratic Party (PDP) flag dey lead wit 254, 698 votes.

INEC returning officer, Professor Adeola Afuwape tell tori pipo say since dem cancel 3598 votes for polling centres for some areas for Osun and na only 353 votes wey PDP use take pass APC then im go declare di election, 'inconclusive', wey mean say clear winner no dey.

INEC say na 27 September dem go repeat elections for di seven areas wey dem cancel di result and na just APC and PDP candidates go dey di ballot.